Manilla Exchange
Category: Cryptocurrency
Published on September 21, 2023
Table Of Content - Clickable
Manilla na new person to person cryptocurrency exchange wey don go far for pay pay matter for blockchain.
Dem dey do new new things wey dey different from wetin others don do, like to buy, sell or exchange your cryptocurrency, to use your cryptocurrency pay bills, etc.
This crypto exchange go serve millions of people for 44 countries for 4 continents. You fit borrow cryptocurrency, stake your cryptocurrency, pay for or buy airtime/data from the exchange platform with cryptocurrency. You fit buy flight ticket or event ticket with your cryptocurrency from the Manilla exchange platform.
Na blockchain technology dem take create the Manilla exchange. This exchange get im own coin wey dem dey call Manilla coin.
Dem sey dem wan use their time and new new technology take give the best person to person exchange platform for the blockchain space.
Security dey very important to dem. Manilla exchange go provide safe, stable environment where buying and selling of cryptocurrencies go take place.
Dem dey partner with other big big businesses wey don dey for a long time to bring better better customer experience.
MANILLA SERVICES
- Person to Person Exchange: you go fit trade cryptocurrencies with people and your mind go strong kamkpe sey you go get competitive rate, e no matter the device wey you use.
- Staking: This na when you keep your crypto assets wey you neva wan use for the exchange platform make dem dey use am dey trade then dey put small small interest on top your asset for you.
Dem dey allow the staking of only stable coins. People wey get Manilla coin (MNLA) wey wan be part of the DAO fit lock their Manilla coin/token for the Manilla vault, so dem self fit share the profit from the Manilla Profit Sharing Program.
- Pay for Utilities: You fit carry the crypto currency wey dey your Manilla wallet pay for your electric bill, your water bill and plenty more for over 5 continents without paper money wey dem dey call fiat. This one go start from Nigeria (PHCN) and Kenya (KENGEN) first.
- Lending: You fit use your tradable Manilla assets as collateral take borrow money to take solve emergency problems, instead of you to go sell your crypto assets at a loss. Make you no worry about high interest for short time because your assets wey dey locked go dey earn interest for you.
- Airtime and Data: This Manilla airtime and data solution dey simple and very fast. E dey connect over 800 telecom operators to end users for over 180 countries of the world, but dem go first start with 44 countries
- Gift Cards: You fit buy or sell gift cards of international companies or the ones wey dey for our area like Amazon, Apple, Google play, Nintendo, even Xbox or even dash am to person. This service go dey available for 180 countries, but e go start for 44 countries first.
- Manilla Card: Dem go provide Manilla debit card for their users so that e go help dem buy and sell crypto currencies freely. People fit use the card do dier normal day to day transactions without fear sey dem go charge big big transaction fee or card maintenance fee.
HOW MANILLA TAKE DIFFERENT
Dem create Manilla exchange to correct the problems wey other exchanges get.
- Security: Dem make Manilla exchange make e fit carry hundreds of thousands of transactions for the same time. Dem know sey plenty people go dey use the platform and na so thieves too go wan follow, so dem don use and still dey use many many things to make sure sey Manilla exchange dey safe for both person wey dey buy and person wey dey sell. Dem dey always check am to make sure sey thieves no go get room to steal.
- Easy to Use: Dem make the Manilla exchange platform easy to use so that new new people wey dey use cryptocurrency fit use the platform and dem fit use any device access the platform.
- Referral System: Even when you no dey trade, you fit get big money when you dey invite people dey come the Manilla exchange platform. When you bring reach 5 people for Manilla exchange platform you go get 25% of the trading money wey the people use dey trade. When the people wey you bring trade or use the Manilla exchange do something dem go dey give you commission.
- DAO Protocol: Manilla exchange na upgrade to the exchange platforms wey already dey, and dem go even dey better when the people wey dey use the platform give review so dem go know new new things wey dem go add, because of this dem don add wetin dem dey call Decentralized Autonomous Organization Protocol.
For the link to the Manilla Exchange white paper click here